Mary Magdalene story


PAULREACH Blog about the story of Mary Magdalena this you will love 

The Story of Mary Magdalene – Told from the Heart of Bayelsa

My brother, make I tell you this tori wey dey always touch my heart. E be like say every time I remember am, e dey remind me say God fit pick person from bottom gutter, clean am, and put am for high chair. Dis na the story of one woman, Mary Magdalene. No be Mary wey born Jesus o! This one na different woman. People sabi her well for her lifestyle. For the kind business wey she dey do, e no be anything wey decent women dey enter. In fact, if we go put am for today’s matter, Mary na person wey dey hustle with her body to survive — yes, she be ashawo.





She no just dey survive, my people, she dey hammer. She dey make serious money from that her work. If na this Bayelsa wey we dey talk about, she for don build lodge, buy car, even dey send money go house for village. She dey use wrapper block her door, and men go just dey enter one by one. Na so the thing be. Nobody fit tell her say wetin she dey do no good, because for her mind, she dey live well.

But something begin happen wey change everything.

She begin hear story. Story about one man called Jesus. A carpenter son wey just dey waka from town to town, village to village, dey preach one kind message — repentance. The thing dey scatter everywhere. People dey hear say blind dey see, cripple dey waka, even people wey don die dey wake up. This Jesus no be ordinary man.

Mary first no send. She still dey do her runs. Until one day, she hear about another woman like her wey dem catch for the very act — adultery. Pharisees, the big big religious men, carry the woman go meet Jesus say, “Oga, this woman don mess up. Moses law say we suppose stone am to death. Wetin you talk?”

Jesus look them, bend down begin write for sand. Then he raise him head come talk one thing wey scatter their head. “Anyone among una wey never sin before, make e throw the first stone.”



Omo, silence choke everywhere. One by one, all of them drop stone waka go. Jesus look the woman tell am, “Go, I no condemn you. But no sin again.”

As Mary hear that story, something shake for her spirit. She begin reason say, “Ah, if Jesus fit forgive that kind woman, e mean say e fit forgive me too.”

Not long after, Jesus come enter one community wey dem dey do one big gathering for one rich man house – dem dey call the man Simon. Plenty people dey the place, and Jesus dey talk, dey gist, dey perform miracle. As Mary hear say Jesus dey there, she say, “Today na today.” She tie her wrapper tight, clean her face, carry expensive oil, and waka straight go the house.

As she enter, wahala start. People begin whisper, especially Simon. “What is this ashawo doing here?” he talk for him mind. “If Jesus na real prophet, e suppose know say this woman na sinner.”

But Mary no even send anybody. She reach where Jesus dey, kneel down for him leg, begin cry. Her tears dey pour like rain. She use her hair – that same hair wey men dey admire – begin clean Jesus leg. Then she bring out the expensive oil, rub am for him feet. The whole place begin smell sweet, like perfume shop.

Simon just dey para for him mind, but Jesus see everything. He look Simon begin yarn him one parable. He say:

“Two people owe money. One owe 2000, the other owe 12,000. Both no fit pay, but the man wey give them the money forgive the two of them. Now tell me, who you think go love the man pass?”

Simon answer, “Na the one wey e forgive the 12,000 na.”

Jesus nod. “You talk true. Since I enter your house, you no give me water to wash leg, no greet me proper. But see this woman, since she enter, she never stop to wash my feet with her tears. She use her hair clean am. She rub expensive oil. Why? Because she know say she don sin plenty, but she don receive mercy.”

Then Jesus look Mary – that same woman wey people dey call prostitute – and say, “Your sins are forgiven. Go and sin no more.”

My people, na so Mary life change. From that day, she no return to that lifestyle again. She begin follow Jesus, dey serve him with her substance. She become one of the women wey stand by Jesus till the very end, even when him disciples run. She dey there when dem crucify am. She dey there when dem bury am. And na she first see am when he rise from death.

You see life? The same woman wey people dey use gossip, the same person wey society reject, na she God choose to show the greatest miracle first — the resurrection.

If God fit forgive Mary, if Jesus fit pick her from that kind place, clean her up, and give her new life, then who you be wey e no fit change? Wetin be your own sin wey too big pass her own?

This story no be just for reading. Na for you and me. No matter where you don fall reach, no matter how far you don waka, once you hear Jesus voice and come with your true heart, he go welcome you. No judgment, just love. No condemnation, just mercy.

So if you dey like Mary that time, thinking say your own don finish, make you remember say her story change — and your own fit change too.



Post a Comment

0 Comments